Shey you don hear? Na 1.67 million Nigerians don japa for motherland. No be me talk am o. Na dat ogbonge company wey dey collect data, Statisense talk am. Dem get the informate from United Nations. Dem say dis na di situation for 2020.
Chai! In dat informate, na Naija carry nomba eight for japa levels among all di whole African kontri. E shock you? But the kontri wey carry first na Egypt with 3.61m japa pipu. Morocco follow dem with 3.26m. South Sudan own bi 2.58m. Sudan japa pipu reach 2.10m. Somalia pipu sef say na japa be dem portion as 2.03m don komot.
Algeria no dey carry last at all as per say dem own japa pipu bi 2.02m. DRC chook mouth for japa with a whole 1.83m. Burkina Faso say japa no bi big deal as dem people reach 1.60m. Mali come be 1.30m for japa levels.
Ah beg, look down see something for yasef.
AFRICAN MIGRANTS – LIVING IN OTHER COUNTRIES 2020
1 Egypt: 3.61m
2 Morocco: 3.26m
3 South Sudan: 2.58m
4 Sudan: 2.10m
5 Somalia: 2.03m
6 Algeria: 2.02m
7 DRC: 1.83m
8 Nigeria: 1.67m
9 Burkina Faso: 1.60m
10 Mali: 1.30m
#StatiSense
(UN)