Sey you don hear? Oga wey dey in charge of transport mata for Lagos House of Assembly, Hon. Temitope Adewale, don talk say the Red Line train go dey carry 500,000 every day.
Dis one mean say na 3.5 million pipu dem go carry for every week and passengers and 15 million every month.
Adewale tok dis tin on Thursday when he go with him committee to see wetin dey happun for train stations wey dey between Ifako-Ijaiye and Yaba.
Adewale say the project don nearly complete and e dey important as government bi wan take am deal with transport wahala for Lagos.